Aug 27, 2005 19:22
"Na tief-man and him people,"
"you done finish? make we help
you small. Oya, everybody!"
"My frien, we don try our best
for call dem but I tink say dem
all done sleep-o... So wetin we
go do now? Sometaim you wan call
soja? Or you wan make we call
dem for you? Soja better pass
police. No be so?"
"Awrighto. Now make we talk
business. We no be bad tief.
We no like for make trouble.
Trouble done finish. War done
finish and all the katakata
wey de for inside. No Civil
War again. This time na
Civil Peace. No be so?"
"We know say you no get plenty
of money. But we sef no get
even anini. So derefore make
you open dis window and give us
one hundred pound and we go
commot. Orderwise we come for
inside now to show you guitar-boy
like dis."
"Ah, missisi de cry again. No
need for dat. We done talk say
we na good tief. We just take
our small money and go nwayorly.
No molest. Abi we de molest?"
ok. maybe its just me...
but i understood very little
of that entire conversation.
I mean... i knew this was
advanced
sophomore english...
but come on now.
this is just ridiculous.